Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 23:35 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

35 Di pipol still stand der dey look, but dia leaders dey laf Jesus sey, “E save oda pipol. Make e save ensef if e bi di Mezaya wey God choose!”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 23:35
24 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Naw, I fit kount all my bones and my enemies dey laf as dem dey look mi.


God sey, “Na my savant wey I give pawa bi dis; di pesin wey I choose and I dey happy with am. I don put my Spirit inside am and e go judge di nashons well.


Una don kom meet Christ, wey bi di stone wey dey alive. Pipol rijet am, but God choose am and e dey important for God eye.


Wen di Farisee pipol (wey like money) hear dis one, dem kon dey take Jesus make yeye.


“Na my savant wey I choose bi dis, di One wey I love, wey I dey happy with. I go put my Spirit inside am and e go judge di world.


Pipol rijet am and dem nor like am at-all. E bear sofa and pain well-well. Nobody even sorry am and wi trit am like sey e nor mean anytin.


Naim one vois from heaven kon sey, “Dis na My pikin wey I love and e dey make belle sweet mi.”


“Den I go pour my spirit to pray and to show mesi for David shidren-shidren body and di oda pipol for Jerusalem. Dem go dey look mi, di pesin wey dem shuk, den dem go mourn like pesin wey dey mourn en only pikin. Dem go kry well-well like sey na dia first boy pikin die.


I don turn pesin wey pipol dey laf and sing yeye song for.


God wey bi di Holy One and di Pesin wey save Israel; di Pesin wey wi dey sin against; wey dey serve rulers, dis na wetin E tok, “Kings go si yu kon stand, prince go bow down, bikos of God wey dey good wey bi di Holy One for Israel and naim choose yu.”


Dem dey sey, “God don rijet am. So make wi go katch am, bikos nobody go help am again.”


bikos dem don curse di pesin wey bi yor own. Wen Yu ponish pipol wey bi yor own, na dis wiked pipol dey karry di matter go evriwhere.


But wen I fall, dem go dey happy kon gada demsef togeda dey dance. Dem gada togeda to kause wahala for mi and dem nor gri stop or taya.


Na how long pipol go take dey tok bad about mi? How long una go dey tok wetin I nor do? How long una go kontinue to dey lie for my head?


Den Pilate koll di priest oga dem, di eldas and di pipol for dat place


One of di tif dey shaut for Jesus, “Nor bi yu bi di Mezaya? Make yu save yorsef and us naw!”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka