Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 23:25 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

25 E kon free Barabas, wey di pipol wont, wey dem bin put for prison, bikos e kause wahala and kill pesin for di town.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 23:25
12 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Una sey una nor wont Jesus Christ, di holy and Raitious Pesin, instead una sey make dem release anoda pesin wey dey kill pipol give una.


Bikos Pilate one do wetin di pipol wont, e kon free Barabas for dem, den afta e tell en sojas make dem flog Jesus, e kon give Jesus to di pipol make dem go kill-am.


Den, dem kon dey shaut, “Wi nor wont dat man, na Barabas wi wont and na criminal dis Barabas bi.”


But dem still sey, “E dey kause wahala with wetin e dey tish pipol for Judea. E start am for Galilee and naw e don kom here!”


dey akuiz am sey, “Wi hear dis man wen e dey deceive and tell awa pipol sey make dem nor pay tax give Caesar and e dey tok sey naim bi Christ, wey bi king.”


Den Pilate release Barabas give dem. Afta dem flog Jesus Christ, Pilate kon gi-am to dem make dem nail am for cross.


Naw make una look! Na di king wey una choose bi dis; di king wey una ask for. Si, God don give una king.


So Pilate orda en sojas sey make dem give Jesus to di pipol make dem go kill-am.


As dem dey take Jesus komot, dem kon katch one man wey dey kom from Sirene and en name na Simon. Dem put di cross for en back make e karry am follow Jesus.


So Pilate kon gi-am to dem make dem go kill-am. Den dem kon take Jesus komot for der.


Di king tell am, “Make yu nor worry about di money, just go do wetin yu like with di pipol.”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka