Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 22:63 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

63 Di guards bigin laf Jesus kon dey beat am anyhow.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 22:63
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Afta Jesus don tok finish, one of di High Priest savant, wey stand near am slap am for face kon ask am, “Na di High Priest yu dey tok to like dis?”


Wen dem curse am, e nor ansa back; wen e sofa, e nor treaten sey e go pay dem back, but e put ensef for God hand wey nor dey judge kase with parsha.


Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.


Jerusalem pipol, make una gada unasef like sojas, bikos enemies dey hide won kon attack una. Dem go use rod take nak Israel leaders face.


Pipol rijet am and dem nor like am at-all. E bear sofa and pain well-well. Nobody even sorry am and wi trit am like sey e nor mean anytin.


Pipol go sopraiz wen dem si am, bikos dem bin beat am well-well and e nor bi like human being again.


God wey bi di Holy One and di Pesin wey save Israel; di Pesin wey wi dey sin against; wey dey serve rulers, dis na wetin E tok, “Kings go si yu kon stand, prince go bow down, bikos of God wey dey good wey bi di Holy One for Israel and naim choose yu.”


Make Yu nor let dem sey, “Si, wi don get wetin wi wont! Wi go chop am alive!”


Dem dey open dia mout against mi like lion wey dey hongry.


Den Pita go outside, bigin kry.


As dem dey der, di High Priest bigin dey ask Jesus kweshon about en disciples and wetin e tish.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka