Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 22:30 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

30 For my kingdom, una go sidan chop and drink for my tabol and una go sidan for difren thrones dey judge di twelf tribes for Israel.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 22:30
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Jesus ansa am, “I tell yu true word, for dat time wen evritin go dey new, Man Pikin go sidan for en throne wey get glory and una wey dey follow mi, go sidan for twelf thrones, dey judge di twelf tribes wey dey Israel.


Many pipol from east and west go kom follow Abraham, Isaak and Jakob chop inside God Kingdom.


Bikos I bear rish di end kon follow my Papa sidan for en throne, anybody wey fit bear rish di end, go follow mi sidan for my throne too.


Wen one of di pipol for di party hear wetin Jesus tok, e kon tell Jesus, “God don bless evribody wey go chop for di party for en kingdom!”


Di savant wey en oga go kom back kon meet am dey work, make e happy well-well bikos di oga go prepare ensef make e for serve di savant food for tabol.


Den di angel tell mi, “Rite dis tin wey I won tok naw: ‘God don bless pipol wey en invite kom chop for di Lamb marriage!’ ” E still tell mi sey, “Dis na God true word.”


Twenty-four oda thrones dey round di first throne and twenty-four eldas sidan put for di thrones. Dem wear white klot and gold crown dey dia head.


Just as sheep dey waka like mumu, na so too dem go dey waka until dem enter dia grave; di place where Deat go bi dia shepad and oga. For morning, pipol wey dey fear God go rule ova dem. Dia body go rotin for grave wey nor even dey near dia fine house.


E good make di king kill all my papa family pipol, but yu give mi pawa make I take chop for yor tabol. I nor get rite to ask for any oda tin from di king again.”


“God go bless una wey dey poor for spirit, na una go get heaven.


If wi bear with am, den wi go reign with am too and if wi sey wi nor know am, en too go sey, e nor know us.


Mi James, wey bi God and Jesus Christ savant, dey greet una wey bi di twelf tribes wey dey for evriwhere for di world.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka