Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 22:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 So, Satan enter inside Judas Iskariot, one of Jesus twelf disciples.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 22:3
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Before dem start to chop evening food, devil don already enter Judas Iskariot mind, wey bi Simon pikin sey, make e sell Jesus give en enemy.


“Wetin I dey tok so nor koncern all of una, bikos I know di pipol wey I choose. Dis show sey God word na true sey, ‘Di pesin wey follow mi chop don turn to my enemy.’


But Pita tell am, “Ananias, why yu allow Satan enter yor heart and yu kon dey lie give di Holy Spirit? Why yu keep some for di money wey una sell di land, for unasef?


“I wont make una know sey, di pesin wey go sell mi give my enemy dey chop with mi for dis tabol.


Even my best friend, di one wey I trust with evritin; pesin wey wi dey chop togeda, don turn against mi.


(Judas tok like dis, nor bi sey e kare for poor pipol, but bikos na tif e bi. As e bi sey naim dey keep di money, e dey tif from am.)


Judas (James pikin) and Judas Iskariot wey leta sell Jesus give en enemies.


Jesus ansa dem, “Di pesin wey go put hand inside plate with mi, na-im go sell mi.


Jesus ansa, “Komot here, devil! Bikos God word sey, ‘Na only God wi suppose to serve and woship.’ ”


Simon wey bi Zealot (pesin wey dey fight for en kountry) and Judas Iskariot wey sell Jesus Christ.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka