21 “I wont make una know sey, di pesin wey go sell mi give my enemy dey chop with mi for dis tabol.
Even my best friend, di one wey I trust with evritin; pesin wey wi dey chop togeda, don turn against mi.
Jesus ansa, “Na di pesin wey I go give dis bread afta I don shuk am inside di pot.” Den e shuk di bread inside di pot kon gi-am to Judas Iskariot, wey bi Simon pikin.
My klose friends dey look mi with shame and di ones wey I love, don turn against mi.
Wen evening rish, Jesus kon go di house with en twelf disciples.