Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 22:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Bikos I tell una, from naw go, I nor go drink dis wine again, until God Kingdom go kom.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 22:18
22 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I tell una, from naw go, I nor go drink dis wine until di day wey I go drink di new wine with una for my Papa kingdom.”


Bikos I tell una, I nor go chop am again, until evritin don komplete for God Kingdom.”


I tell una true word, I nor go drink wine again, until di day wen I go drink di new wine for God Kingdom.”


God sey, “All of una wey wota dey hongry, make una kom drink from dis wota! Una wey nor get money, make una kom chop! Make una kom drink wine and milk and una nor go pay anytin!


E save us from darkness pawa and put us for di kingdom wey E give di pikin wey E love.


Na so una go still know too, wen una si all dis tins dey happen, una go know sey God Kingdom don near.


But I tell una true word, some pipol wey stand for here nor go die, before dem go si God Kingdom.”


Dem gi-am wine wey dem mix with myrrh, but Jesus nor gri drink am.


Afta, e take cup, tank God, den e give en disciples and all of dem, drink from inside.


Jesus kon tell dem, “I tell una true word, some pipol dey here wey nor go die until dem don si God Kingdom and en pawa.”


And I tell yu, yu bi Pita, wey mean rock and on-top dis rock, I go build my church and di gate for hell nor go fit skata am.


Dem go dey good and fine well-well! Di korn and wine wey di yong pipol go dey chop and drink, go make dem grow and dey strong.


Oga God wey get pawa go protet en pipol and dem go distroy dia enemies. Dem go dey shaut for war like who drink dey katch and dem go kill dia enemies finish. Dia enemies blood go plenty well-well like sakrifice blood wey dem pour put for di altar.


For di time wey dis kings go dey rule, God wey dey heaven go raiz one kind kingdom wey nor go ever end. Dem nor go fit distroy di kingdom and anoda pesin nor go rule am. E go distroy and skata all di oda kingdoms. But dis kingdom go stand forever.


For Mount Zion, God wey dey lead heaven sojas go do big party for all di pipol for di world. For di party, plenty food go dey to chop and wine go dey to drink; betta meat and sweet wine go dey too.


I don enter my gardin, my treasure and wife to bi! I don gada myrrh with spices and I don chop my honi-komb and my honey; I don drink my wine and my milk! Una wey sabi love, make una chop and drink until love shark una.


wine wey go make us happy; olive oil wey go make awa skin good and bread wey go give us strent.


“But di grape vine ansa, ‘I nor go fit stop to produce my wine wey dey make gods and human being happy, just bikos I won bi una king.’


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka