13 Wen dem go, dem kon si evritin as Jesus tell dem sey e go bi, so dem prepare di Passova food for der.
Heaven and eart go vanish komot, but my word go dey forever.
So di pipol wey dem send go, kon rish di place wey Jesus tell dem.
Na faith make Abraham obey wen God koll am make e leave en house, travel go anoda land wey God promise am, even doh e nor know where e dey go.
So en mama kon tell di savants sey, “Anytin wey e tell una, make una do am.”
Jesus tell am, “I nor tell yu before sey, ‘Yu go si God pawa, if yu bilive mi?’ ”
E go show una one big room where tabol and chair dey for upstair. Make una prepare evritin for der.”
Wen di time rish, Jesus sidan for where dem dey chop and en disciples kon join am.