6 As dem dey for Betlehem, time kon rish for marry to born.
But God plan go stand forever; wetin E plan, nor go shange at-all.
Di time kon rish for Elizabet to born, so e kon born boy.
But yu, Betlehem Efrat yu bi one small town for Judah. But na from yu di pesin wey go rule Israel go from kom and en family dey among Israel pipol since.
Pipol fit plan difren-difren tins, but na wetin God tok, go happen.
Josef and Mary wey e won marry wey get belle, go register togeda.
So e born en first son, wrap am kon put am for where dem dey keep animal, bikos know oda place dey for dem to stay.