Wen en papa and mama si am, dem sopraiz well-well. Naim en mama sey, “My pikin, why yu do us like dis? Si, mi and yor papa dey find yu for evriwhere since.”
Den Jesus enter di temple aria kon drive all di pipol wey dey buy and sell inside di temple, e skata di tabol and chair wey di pipol dey take shange money and sell dove.
But I get pesin wey go bear witness about mi wey big pass John, bikos di work wey my Papa give mi make I do, naim I dey do so; so di work dey bear witness sey, na my Papa send mi.