Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 2:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Di angel tell dem, “Make una nor fear! Make una listin well, bikos I kom tell una news wey go make pipol happy.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 2:10
30 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So Jerusalem, make yu go on-top high mountin. Make yu prish di good news! Koll Zion pipol with loud vois, den announce di good news! Shaut as yu dey tok and nor fear at-all. Make yu tell Judah towns sey God dey kom!


God wey dey mighty, en Spirit dey on mi, bikos E don anoint mi to prish good news give poor pipol; heal doz wey dia heart break; announce make dem release doz wey bi slave and free doz wey dey for prison.


Si as e dey good to si messenja wey dey kom give una peace and good news from di mountins! E dey announce sey una don win kon tell Zion pipol sey, “Una God na king!”


Den Jesus Christ waka near kon tell dem, “God don give mi all di pawa wey dey heaven and eart.


I go bless doz wey bless yu, but doz wey curse yu, I go curse dem too. All di family for dis eart, go get blessing, bikos of yor name.”


But Jesus tell dem, “Make una heart strong! Na mi, make una nor fear.”


Den di angel tell am, “Make yu nor fear, Mary, bikos God don favor yu!


Na mi God first tell Zion sey, ‘Dis na wetin go happen.’ I send betta news go Jerusalem sey, ‘Una pipol dey kom! Dem dey kom house back!’


If true-true una get faith and una leg strong for groun, den una go get hope kon whole di gospel wey una hear. Dem don prish dis gospel give evribody for di world and mi Paul don bi di gospel savant.


And wi dey tell una di Good News about dis tins wey God promise awa grand-grand papa dem.


and dem go use en name prish give pipol make dem for turn from dia sin kom meet God and di prishin go start from Jerusalem.’


Afta sometaim, Jesus kon travel go all di town and village dey prish di Good News about God Kingdom. Di twelf apostles


Na mi small pass for all God pipol, but God don give mi grace to prish di Good News give Gentile pipol and dis grace wey Christ give mi, nor dey finish.


Di angel ansa, “I bi Gabriel, wey dey stand for God present and na-im send mi kom tell yu dis Good News.


Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.


But di angel tell am, “Make yu nor fear Zekaraya, bikos God don hear yor prayer. Yor wife Elizabet go born boy pikin for yu and yu go koll am, ‘John.’


“Di time wey God promise sey en kingdom go kom don rish. So make una leave di sins wey una dey do kon bilive di Good News.”


God tell mi, “My savant, I get big work for yu; yu nor go only make Israel pipol wey survive, great again, but I go still make yu di lite for di nashons, so dat all di world go dey save.”


How pesin go prish God word wen God nor send am? As God word sey, “Pipol wey dey prish di Good News dey waka well, bikos na good tins dem dey bring!”


Jesus kommand dem sey, “Make una enter evriwhere for di world go prish di gospel give evribody.


But di angel tell di wimen, “Make una nor fear, I know sey una dey look for Jesus Christ, wey dem nail for cross.


E sey, “Make yu nor fear, God love yu well-well! So nor let anytin worry yu. Make yu dey strong! Wen e don tok like dis, my body kon strong more-more.” Den I sey, “Oga! Yu don make mi dey okay naw.”


God go use en holy pawa take save en pipol and di whole world go si am.


Today, dem born una Savior for dis town wey David from kom, en name na Christ, wey bi di Oga God.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka