37 As e dey enter di road wey go Mount Olives, all di disciples kon dey happy, dey praiz God with loud vois for all di mirakles wey dem si.
As Jesus and en disciples near Jerusalem, dem kom rish Betpage for Mount Olives, so Jesus send two disciples
“Den anoda savant kon sey, ‘Oga God, si di money wey yu give mi. I keep am inside klot.
At wons, di man bigin si and e kon follow Jesus, dey praiz God. Wen di pipol si wetin happen, dem kon bigin praiz God.
Fear katch all of dem and dem kon dey praiz God sey, “Na big profet kom meet us so-o!” and “God don kom help en pipol!”
Afta dem don sing one hymn, dem kon enter inside Mount Olives.
As Jesus sidan for Mount Olives wey face di temple, Pita, James, John and Andru kom meet am wen odas nor dey and dem kon sey,
King Hezekaya and all di pipol happy well-well for wetin God do for dem, bikos E kwik-kwik do am.
So evribody for Israel follow di Kovenant Box go rish Jerusalem dey happy, dey play trumpets, horns and cymbals kon dey sing and dance.
Wen e rish Betpage and Betany, for di place wey dem dey koll Mount Olives, e kon send two of en disciples sey,
As Jesus dey ride dey go, pipol kon spread dia klot for road.
And dem gada go meet Jesus, bikos dem hear sey na-im wake Lazarus from grave.