Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 19:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 Bikos I dey fear and know sey yu hash well-well. Yu dey chop food wey nor bi yor own and yu dey plok fruit wey yu nor plant!’

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 19:21
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

e dey kom judge evribody, so dat pipol go know di bad tins wey dem dey do and di wiked words wey sinnas don tok against God.”


Dis kind love nor get fear, bikos betta love dey drive fear komot from pesin heart. If wi dey fear bikos wi nor wont make God ponish us, dat show sey wi neva really know how en love bi.


Di pesin wey dey do evritin wey dey di law and e break one, don break all of dem bi dat.


Bikos God nor give us di spirit wey go make us fear, but di spirit wey E give us, get pawa, love and sef kontrol.


Di Spirit wey God give us nor go make us fear like slave, instead, wi bi God shidren and wi dey koll am, “Awa Papa!”


Pipol wey dey sin, na God enemy dem bi, bikos dem nor obey en law, since dem nor fit obey am.


Den Samuel tell di pipol, “Make una nor fear. True-true, una don sin. But make una nor turn from God. Make una serve God with all una heart.


“Den anoda savant kon sey, ‘Oga God, si di money wey yu give mi. I keep am inside klot.


“Di oga kon tell am, ‘Na yor word I go take judge yu, yu wiked savant! So yu know sey, I bi hash man; dey chop food wey nor bi my own and I dey plok fruit wey I nor plant?


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka