Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 18:9 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

9 Jesus kon tell dis parabol to some pipol wey bilive and feel sey, na dem holy pass and nobody good rish dem.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 18:9
22 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But Jesus tell dem, “Na una dey make unasef good for pipol eye, but God know una heart. Bikos wetin human being value well-well, naim God nor like.


“Dem bilive sey dem dey good for dia own eye, but dem dirty pass rag.


Dem dey tell odas sey, “Make una nor near us, wi dey too holy for una to tosh! Doz pipol bi like smoke for my nose, bikos my vexnashon for dem bi like fire wey nor dey kwensh.


as e bi sey dem nor know how God dey take make pipol good, instead, dem dey try to make demsef good by dia own pawa, since dem nor gri do wetin God wont.


But why yu dey kondemn oda Christians? Why yu dey si dem as small shidren? Di day dey kom wen God go judge all of us.


Wen di Farisee wey invite Jesus si wetin dey happen, e kon tok for en mind sey, “If dis man na profet true-true, e for know sey dis woman wey dey tosh am so, na sina e bi.”


Before I know di law, I dey alive, but wen I hear God kommandment, sin just enter my life


Wen di pipol si wetin happen, dem kon dey komplain dey sey, “Jesus don go visit dat man wey bi sina.”


Di Farisee kon stand dey pray about ensef sey: ‘God, I tank yu sey I nor bi like oda pipol wey dey play wayo, dey sin, pipol wey dey kommit adultery or even like dis tax kollector.


But di Oga God sey, ‘Go, bikos I go send yu go far-far go meet Gentile pipol.’ ”


Dem kon tell di man, “Na for inside sins born yu, yu tink sey yu go fit tish us anytin?” So dem drive am komot from di place.


Dem shaut for di man kon sey, “Na yu bi en disciple. Wi bi Moses disciples.


So di pipol kon sey, “E bi like sey yu bi Samaria pesin and demon dey inside yu.”


But di Farisee pipol and di law tishas dey komplain sey, “Dis man dey follow sinnas chop.”


But di man won show sey en know well-well, so e kon ask Jesus, “Who bi my neighbour?”


Make una listin to wetin God tok, “Una own pipol hate and porshu una bikos una dey obey my name. Dem dey laf una sey ‘Oya! Make una honor God name na! Make belle sweet una na!’ ” But make una nor worry, bikos na dem go shame.


Since God dey welkom evribody, make una nor kondemn odas bikos dem chop or dem nor chop wetin una like.


Di priest go look di sore again for di sevent day, if e neva spread or yellow and e nor deep pass di skin wey dey near am,


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka