Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 18:39 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

39 So di pipol wey dey en front kon dey shaut for am make e kwayet, but e kon dey shaut more-more, “David pikin, make yu sorry for mi o-o!”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 18:39
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

My Oga God, I dey koll Yu, so make Yu kwik kom! Make Yu listin wen I kry to Yu for help!


Some pipol kon bring dia pikin make Jesus tosh dem. But wen di disciples si dem, dem kon bigin shaut for di pipol wey bring di shidren.


Na three times I ask Christ sey, make e take dis tin komot from my body.


But some Farisee pipol wey dey among di pipol kon tell Jesus, “Tisha, make yu tell yor disciples make dem kwayet.”


So di man kon dey shaut, “Jesus, David pikin, make yu sorry for mi o-o!”


Den Jesus tell dem one parabol to show sey, e good make pipol dey always pray.


“Curse dey una head! Una wey know di law well-well! Una don seize di key wey dey make pipol know di trut! Since una nor gri enter, una nor wont make oda pipol enter too.”


As Jesus still dey tok, somebody run kom from Jairus house kon tell Jairus sey, “Yor pikin don die, so make yu nor worry di tisha again.”


“Wen yu ask for sometin, God go gi-am to yu; wen yu look for sometin, yu go si am and wen yu nok, di door go open for yu.


Jesus ansa dem, “Una faith small o-o. Wetin make una dey fear?” Den e get up, kommand di breeze and di wave sey, make dem stop and evriwhere kon kwayet at wons.


As Jesus komot for der, two blind men kon follow am dey shaut, “David pikin, make yu sorry for us!”


So Jesus stop kon sey make dem bring di beggar kom meet am. Wen di man kom, Jesus ask am,


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka