Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 17:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Make yu shine yor eye! “If yor broda sin, make yu tell am. If e turn from sin kom meet God, den, make yu forgi-am.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 17:3
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Make una nor keep malice with anybody, but make una setol una kworel with dat pesin, so dat una nor go sin, bikos of dat pesin.


Den Pita kon ask Jesus, “Oga God, how many times I go forgive my broda wey do mi bad? Na seven times?”


So, nor ever korrect proud pipol, bikos dem go hate yu; but if yu korrect wise pesin, e go respet yu forever.


My brodas and sistas, if anybody among una waka komot from di trut and pesin bring am kom back,


E betta make yu korrect pesin for open, dan to dey show am love for sekret.


So make una dey kareful, so dat una nor go break di kovenant wey una make with di Oga una God. Make una nor make any juju for unasef, bikos una God nor like am.


But make una look well! Make una dey kareful, so dat una nor go forget wetin una don take una eyes si. As long as una dey life, make una nor let dis tins komot from una mind! Make una make sure sey una tell una shidren and grand-shidren about dis tins.


“Make una dey kareful, so dat una nor go make kovenant with di pipol wey dey di land wey una dey go, if not, e go bi trap for una.


Make una shine una eye, so dat di work wey wi do among una, nor go lost, but instead, wi go get komplete reward.


Make una make sure sey nobody turn back from God grace and make nobody get bad belle and kause trobol wey go make pipol sin.


Make una dey kareful as una dey live una life. Make una nor bi like pipol wey nor get sense.


“So, make una shine una eye! Nor let party and wahala for dis life full una mind, if not, dat Day go kom wen una nor espect,


Pesin wey get sense dey take korreshon if dem korrect am wons, but foolish pesin go only take korreshon afta dem don beat am well-well.


Make pipol wey dey fear God beat and korrect mi with love! Make my head nor rijet good oil! True-true, even with all dia wiked plans, my prayers dey make dem fear.


But make una dey kareful, bikos una nor know as God bi even wen E dey tok to una for Mount Sinai from inside di fire.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka