Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 16:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 “Den di manaja tell ensef, ‘Wetin I go do naw? My oga won sak mi and I nor strong rish to dig and na shame for mi to go beg.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 16:3
26 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Wi hear sey some pipol among una dey leave anyhow and dem nor dey mind dia business, instead dem dey put eye for anoda pesin tin.


Some pipol dey always karry one man, wey nor fit waka since en mama born am, kom di temple door-mot wey dem dey koll, “Beautiful Gate”, so dat e go dey beg for money from pipol, wey dey enter inside di temple.


Den en neighbours and oda pipol wey dey si am dey beg before, kon ask sey, “Dis nor bi di man wey dey sidan dey beg for money?”


“Di judge nor first listin to am, but afta, e tok for en mind sey, ‘Aldo I nor dey fear God and respet anybody,


“Di poor man kon die and angels karry am go where Abraham dey. Di rish man still die too and dem beri am.


But for en gate, one poor man wey en name bi Lazarus and sore full en body, liedan for der,


so e kon tink for en mind sey, ‘Wetin I go do naw? Bikos I nor get anywhere to keep all dis food wey I plok so.’


Dem kon go Jeriko. As Jesus and en disciples with plenty pipol dey komot for der, Bartimaeus wey bi Timaeus pikin, one beggar wey blind, sidan for road dey beg.


So na wetin una go do wen festival time rish? How una go take do Oga God festival?


Di profet dem dey lie; di priests dey rule as dem like and my pipol like am like dat. But di day wey wahala and distroshon go start, na where dem go run go for help?


Naw, wetin una go do wen God won judge una? Wen God bring wahala from far kountry kom meet una, na who una won run go meet make e help una? Where una go hide una propaty and money put?


If yu give yor savant evritin wey dem wont from small kom, one day, dem go take evritin wey yu get.


Farmer wey lazy well-well to klear en farm for di rite time, nor go get anytin to harvest.


If yu like, dey lazy and dey sleep anyhow, but make yu know sey honga go soon kom kill yu.


Lazy pesin bad like pesin wey dey distroy tins.


If yu dey lazy, tins nor go eazy for yu, but if yu dey do wetin dey rite, trobol go dey far from yu.


Lazy pipol won get plenty, but na small dem dey get, while doz wey dey work hard, dey prosper.


So Haman enter inside and di king kon tell am, “Wetin wi fit do for di man wey di king like to honor?” Haman kon tink for en mind sey, “Wish pesin di king go wont honor, escept mi?”


Naw, make yu get up go inside di town and dem go tell yu wetin yu go do.”


“Wen evening rish, di pesin wey get di farm kon tell en managa, ‘Koll di workers make yu pay dem, start from di last pipol wey I hire.


So e koll di manaja kon tell am, ‘I nor like wetin I dey hear about yu. Make yu go rite how yu take dey spend all my money, bikos yu nor go bi my manaja again.’


I know wetin I go do, so dat wen my oga sak mi, I go get friends wey go welkom mi for dia house.’


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka