Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 16:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 E betta make heaven and eart vanish, dan make even di small-small laws dey yuzles.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 16:17
11 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I tell una true word, before dis world go end, evritin wey dey inside di Law, even di small-small ones, go happen.


Heaven and eart go vanish komot, but my word go dey forever.


but God word go last forever. And na dis word bi di Good News wey dem prish give una.


Yes, di grass go dry and flower go fade, but awa Oga God word go dey forever.”


So make wi trowey di law bikos of faith? No way! E nor go work! Instead, wi go make di law strong well-well.


So make una look heaven and eart! Di heavens go vanish like smoke, di eart go tear like old klot and all en pipol go die like fly. But wen I diliver am, e go last forever. My viktory, na di final one.


E go klean evry tears from dia eye and deat nor go dey again. To dey mourn, kry and pain nor go dey again, bikos di tins wey dey before, don vanish.”


Den I si new heaven and new eart. Di first heaven and eart nor dey again and di sea vanish.


Den I si one big white throne and di Pesin wey sidan put. Eart and heaven run komot from en present and dem nor si where to hide put.


Di day wen God go kom, go bi like wen tif dey kom for nite. Wen E kom, di heaven go disappear with loud nois and di stars for up go melt, di whole eart and evritin wey dey inside, go vanish.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka