Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 15:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 “But di papa koll en savants kon tell dem, ‘Make una bring di best klot, ring and shoe and make una wear dem for my pikin.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 15:22
30 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den dem give each of dem long white klot kon sey, make una rest small until di oda savants and una brodas for Christ wey wiked pipol go kill, don komplete.


Den di king remove en ring (di one wey e take back from Haman) kon gi-am to Mordekai. And Estha sey make Mordekai kare for Haman propaty.


Den Fero take en own ring from en hand kon wear am for Josef own. E wear en fine klot for Josef kon put gold shain for en neck.


Jerusalem pipol dey happy, bikos of wetin God don do. E bi like yong woman wey dem dress ready for marriage. God don wear salvashon and viktory klot for en body.


Di king kon remove en ring wey dem take dey stamp law, so dat e go get pawa kon gi-am to Haman wey bi Hammedata pikin from Agag and dis Haman na Jew enemy.


Dem allow am wear klean linen wey dey shine, (Dis linen mean di good tins wey God pipol do).


Afta all dis tins, I look up kon si crowd wey nobody fit kount. Dem kom from difren tribe, kountry, group, language and dem stand for di throne and di Lamb front. Dem wear white klot kon whole palm tree branches for hand


Di Spirit wey God give us nor go make us fear like slave, instead, wi bi God shidren and wi dey koll am, “Awa Papa!”


Pesin wey get ear, make e hear wetin di Spirit dey tell di pipol for di church. Anybody wey fit bear rish di end, I go gi-am some manna wey dem hide for heaven. I go gi-am white stone and for dat stone, dem go rite new name put and nobody go fit undastand am, escept di pesin wey I give di stone.’ ”


Una wey dem don baptize inside Christ, don wear Christ for body like klot.


Instead, make una wear Jesus Christ like klot for body. Den wi nor go do di tins wey awa body wont.


Fine woman! Make yu si as yor leg fine for inside sandal. Yor lap round like gold wey betta goldsmit make.


Make yor glory kover yor priest; make joy full yor loyal savants heart.


Di king dota dey always dey happy for en room afta e don wear en fine-fine klot wey dem make with gold.


E make my leg strong for groun like deer own kon make mi fit stand on-top high mountins.


So I advise yu sey make yu buy gold; gold wey dem don polish with fire. Den yu go get plenty money. Make yu still buy white klot from mi kon wear am, so dat dem nor go si yor nakednes again, den buy medicine put for yor eye, so dat yu go fit si.


Make una wear shoe for leg wey go show sey, una dey ready to prish di Good News wey dey give pipol peace


Na di faith wey pesin get for Jesus Christ go make am dey good for God eye. Anybody wey bilive Jesus, God dey make en faith strong, weda e bi Jew or Gentile pesin.


I go protet en priests and joy go full di heart of doz wey dey fear God.


Una gate key go bi iron and bronze and God go guide una forever.


“Den di pikin tell am, ‘Papa, I don sin against heaven and yu. I nor rish make dem koll mi yor pikin again. Make yu take mi as yor worker.’


Den, make una go take di melu wey fat pass, kill-am make wi do party,


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka