Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 15:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 I tell una true word, na so God angels dey happy, wen one sina turn from sin kom meet God.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 15:10
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I tell una true word, na so happiness dey for heaven wen one sina turn from sin kom meet God, pass ninty-nine good pipol wey don already dey with God.


Bikos wen God make pipol sorry for di sin wey dem kommit, dem go turn kom meet am, den God go save dem and dem nor go regret again. But di vexnashon wey dis world dey bring, na deat dey end am.


Tell dem sey, ‘God sey, “As long as mi wey get pawa dey alive, I nor dey happy to si doz wey dey sin, dey die. I prefer make dem stop to sin, so dat dem go get life wey nor dey end. So, Israel pipol, make una stop di wiked tins wey una dey do. Na wetin make una won kill unasef finish?” ’


God wey get pawa sey, “Yu tink sey I dey happy as wiked pipol dey die? No! I go like if dem turn from sin kom meet mi, so dat dem go get life.


I tell una true word, nor bi so e bi! Unless una turn from sin kom meet God, all of una go die too!”


Na like dis too yor Papa for heaven nor wont make any of en shidren lost.”


I nor wont make anybody die.” God wey get pawa sey, “Make una run from sin and una go get life.”


All di angels na savants and na dem God send go prish for pipol wey go get salvashon.


Wen dem hear wetin Pita tok, dem nor argue with am again, so dem kon start to praiz God. Den dem sey, “Naim bi sey God don give Gentile pipol di shance to take turn from sin kom meet am, so dat dem go get di life wey nor dey end.”


Make I tell yu, I don forgive dis woman en many sins, so en love don big well-well, but di pesin wey dem forgive small sin, en love go small.”


“Make sure sey una nor porshu any of dis small shidren komot. I tell una di trut, dia angels dey my Papa front for heaven evritime.


May bi na bikos of dis make am nor dey with yu since, but naw, e go dey with yu forever.


But for dat nite, God angel open di prison door kon bring dem kom out and tell dem,


“Anybody wey tok for publik sey en know mi, na so mi too go tok about am give my Papa for heaven.


“I tell una true word, anybody wey stand up for publik sey en know mi, mi too go stand up for am for where God angels dey.


But pesin wey rijet mi for where pipol dey, mi too go rijet am for where God angels dey.


Wen e don si am, e go koll en friends and neighbours gada kon sey, ‘Make una kom follow mi happy, bikos I don si my money wey lost before.’


Den Jesus sey, “One man dey wey get two sons.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka