33 Like dis too, nobody fit bi my disciple if e nor komot en mind from evritin wey e get.
Levi get up, leave evritin kon follow am.
“If anybody kom meet mi and e nor love mi pass en papa, mama, wife, pikin, brodas and sistas, even en ownsef, e nor go fit bi my disciple.
So wen dem don push dia kenu rish groun for di wotaside, dem leave evritin kon follow Jesus.
Bikos Demas love dis world tins, e kon run leave mi go Tesalonika. Crescens don go Galatia and Titus go Dalmatia.
If e si sey e nor go fit win, e go send messenja wen di oda king still dey far, go ask am how dem go take setol.
E feel sey e betta make dem laf am, bikos of di Mezaya wey dey kom, instead make e dey enjoy di fine-fine tins for Egypt. E do like dis, bikos e put en eye for God reward.