Herod kon dey vex well-well for Tyre and Sidon pipol. So dem gada go si am. But dem kon first beg Blastus wey bi di king offisa, make e help dem beg am, bikos na di king kountry dey supply food give dia kountry.
If yu and pesin get kase and una dey go kourt, make yu try setol with am for road, so dat e nor go drag yu go meet di judge, wey go give yu to sojas and dem go trow yu inside prison.