17 Wen di party time rish, e kon tell en savant make dem go tell evribody wey e invite sey, ‘Make una kom, bikos evritin don ready.’
All dis tins dey kom from God wey make us en friends bikos of Christ and E still give us di ministry wey go make pipol bi en friend.
So my brodas, wey bi Abraham shidren and una wey bi Gentile pipol wey dey fear God, na di message about how God go take save pipol, naim wi kom tell una so.
For di last day for di feast, wey bi di biggest day, Jesus stand kon shaut, “If wota dey hongry anybody, make e kom meet mi.
But Jesus tell am, “One man do big party kon invite many pipol kom.
“But all of dem kon dey komplain one-by-one. Di first one sey, ‘I just buy land and I won go si am. Abeg, make yu nor vex.’