Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 12:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 so e kon tink for en mind sey, ‘Wetin I go do naw? Bikos I nor get anywhere to keep all dis food wey I plok so.’

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 12:17
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Give pipol anytin wey dem ask from yu and nor drive anybody wey kom borrow sometin from yu.”


Make una share una food with pipol wey dey hongry kon open una door for poor pipol wey nor get house. Den give klot to pipol wey nor get anytin to wear and help una own rilashons.


Dis na wetin make us know wetin love bi: Jesus Christ die for us, so wi suppose sakrifice awa life for awa fellow Christian brodas and sistas.


Make una give food to God pipol wey dey hongry and make una dey welkom dem for una house.


E bring dem kom outside kon ask, “My oga dem, wetin I go do to dey save?”


“Di oga kon tell am, ‘Yu do well, yu bi good savant! Bikos yu dey faithful with small tin, I go make yu oga ova ten towns.’


Wen Jesus hear wetin di man tok, e kon tell am, “E still get one tin wey yu neva do, make yu sell evritin wey yu get, give di money to poor pipol, den yu go get betta propaty for heaven. Afta dat, make yu kom follow mi.”


So I tell una true word, make una use una money well, so dat una go make friends for unasef and wen di money finish, God go welkom una for en kingdom wey go dey forever.


Make yu give dis kommand to rish pipol. Tell dem sey, make dem nor dey karry body up kon dey trust dia money wey nor get value and make dem dey trust God wey dey give us evritin wey wi nid to take enjoy dis life.


Wen di pipol hear dis prishin, e trobol dem for mind well-well and dem kon ask Pita and di rest apostles, “Awa brodas, wetin wi go do naw?”


“Den di manaja tell ensef, ‘Wetin I go do naw? My oga won sak mi and I nor strong rish to dig and na shame for mi to go beg.


Make una sell evritin wey una get and give di money to poor pipol. Bag wey nor go tear, make una take am gada betta tins for heaven, where tif nor go fit rish and siti-siti nor go fit spoil dem.


Make una nor dey worry about wetin una go chop or drink.


Jesus tell en disciples, “Naw I dey tell una, make una nor worry about una life, wetin una go chop or klot wey una go wear for body.


But make una from una heart give to pipol wey nor get, so dat evritin go dey klean for una.


One man wey sabi di law well-well kon get up test Jesus, “Tisha, wetin I go do to take get life wey nor dey end?”


John ansa dem, “Di pesin wey get two klot must give one to pesin wey nor get at-all and di pesin wey get food must share with pesin wey nor get.”


But e betta if yu put am for many business, bikos yu nor know where wahala go from kom.


So dem kon dey tok among demsef sey, “Na bikos wi nor bring bread, naim make am dey tok like dis.”


So Jesus kon tell dem one parabol: “One rish man plok plenty food from en farm,


“Den di man sey, ‘I know wetin I go do: I go skata my stores kon build new big-big one wey I go keep all my food and oda tins wey I plok.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka