So I ansa, “If I go warn and tok to dem, na who go gri listin? Dia ear block, so dem nor go hear mi, bikos God word dey make dem vex well-well and dem nor like am at-all.
“Curse dey una head! Una wey know di law well-well! Una don seize di key wey dey make pipol know di trut! Since una nor gri enter, una nor wont make oda pipol enter too.”
But Jesus ansa am, “Curse dey una head! Una wey know di law well-well! Una karry heavy load put for pipol back and una nor won even take hand tosh di load!
King Ahab ansa, “E get anoda one, en name na Mikaya wey Imlah born. But I hate am, bikos e nor dey profesai anytin wey dey good give mi, na only bad tin e dey tell mi.” King Jehoshafat kon sey, “Make yu nor tok like dat!”