Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 11:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Make yu forgive us awa sins, as wi dey forgive doz wey do us bad. Nor let us enter temptashon.’ ”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 11:4
31 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Open yor eye make yu pray, so dat yu nor go fall inside temptashon. Yor spirit won do am, but yor flesh dey weak.”


Make una dey bear with each oda; dey forgive each oda; even doh una get wahala with anybody. Just as Christ don forgive una, make una forgive odas too.


“So, na like dis too my Papa for heaven go do una, if una nor forgive una brodas from una heart.”


Judgement nor get mesi for anybody wey nor dey mesi for odas, bikos mesi betta pass judgement.


And Christ go still save mi from evry evil plan until e take mi enter en kingdom. Make glory bi en own forever and ever. Amen!


But Christ dey keep en promise and E go make una strong.


E nor get anytin wey dey happen to una naw, wey neva happen to odas before, but God dey keep en promise and E nor go allow una pass thru wetin una nor go fit bear.


I nor sey make yu remove dem from di world, but make yu protet dem from di devil.


So Jesus tell dem, “Why una dey sleep? Make una get up pray, so dat una nor go fall enter temptashon!”


Di ones wey fall for where stones dey, na di pipol wey hear God word kon receive am with happiness, but dem nor get rut. Dem bilive small, but wen wahala kom, dem nor bilive again.


Make una turn kom meet God and pray to am sey: “Make Yu forgive us awa sin kon asept awa prayers, so dat wi go praiz Yu.


So make Yu forgive us! Make Yu kwik hear and ansa us. Nor bi just for yor town and en pipol, but na to make pipol honor and praiz yor holy name.”


Make Yu feel my pains kon si my trobol, den Yu go forgive mi all my sins.


Bikos yu don obey my kommandment wey bi to get patient, I go protet yu wen I won test evribody for dis world.


Make yu nor fear di tins wey yu go soon sofa. Devil go trow some of una inside prison, so dat e go test una. Yu go sofa for ten days. But make yu nor live mi, even if e mean sey yu go die. Bikos I go give yu di crown wey bi life.


God dey keep mi from my enemies and E dey protet my life.


My God, bikos of di honor wey yor name get, make Yu forgive mi my many-many sins.


make Yu listin and ansa dem from heaven. Make Yu forgive di king and Israel pipol for dia sins kon tish dem di rite way. Den, my Oga God, make Yu send rain kom dis land wey Yu give yor pipol as dia own forever.


make Yu listin to dem from heaven. Make Yu forgive dem kon bring dem back to di land wey Yu promise dia grand-grand papa.


di Angel wey don protet mi from all wahala, bless dis boys. My name and my papa Abraham and Isaak name go shine for dia life. Dia shidren go many like san-san for dis eart.”


Den Jesus tell dem, “Like sey one of una go meet en friend for mid-nite sey, ‘My friend, abeg give mi three bread,


Doz eighteen pipol wey die wen towa fall for dia head for Siloam, una tink sey na dia sin big pass for Jerusalem?


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka