Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 10:27 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

27 Di man ansa, “Make yu love God yor Oga God with all yor heart, yor soul, yor pawa and mind, den love yor neighbour as yu love yorsef.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 10:27
15 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

So una must love di Oga una God with all una heart, all una soul and all una pawa.


Di law get difren-difren kommand like, “Nor kommit adultery; nor kill pesin; nor tif; nor put eye for anoda man propaty.” All dis na just one kommand wey sey, “Make pipol love odas, just as dem love diasef.”


Di Oga una God go sekonsaiz una and una shidren heart by ensef, so dat una go love am with all una heart and soul, den una go get betta life.


Make una nor revensh anybody or kontinue to dey hate di pesin, but make una love una neighbour as una love unasef. Na mi bi God.


But if una do wetin dem rite for God word, “Make yu love yor neighbour as yu love yorsef,” una don do good bi dat.


Naw, Israel pipol, wetin di Oga una God wont from unasef? E wont make una dey fear am kon dey live di kind life wey E wont make una live. E wont make una love, respet and serve am with all una soul and heart.


My shidren, make wi nor dey love with only word for mout, but make wetin wi dey do, show sey wi really love each oda.


But naw, “Dis na my new kovenant (wey bi di new agriment): Di time dey kom wen I go put my laws for dia mout and rite am for dia heart. I go bi dia God and dem go bi my pipol.


My brodas and sistas, God don koll una make una dey free; but make una nor use di freedom wey God give una anyhow, instead make una love each oda.


respet yor papa and mama and make yu love yor neighbour as yu love yorsef.”


Israel pipol! Make una listin! Di Oga na awa God and God na one!


Jesus kon ask am, “Wetin yu undastand about Moses Law?”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka