Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 10:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

21 For dat time, di Holy Spirit kon make Jesus dey happy, so e kon sey, “I praiz yu, Papa wey bi Oga God for heaven and eart, bikos yu don hide dis tins from pipol wey get sense and wise, but yu show dem to yor shidren. Yes, Papa, na so yu wont make e bi.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 10:21
29 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

But even if dem use klot take kover di gospel wey wi dey prish, doz wey don lost, na only dem nor go si am,


All tins dey happen as God wont am and thru Christ, E choose us to bi en own pipol, bikos na so E plan am from di time wen E kreate di world,


Before, God don already decide thru Jesus Christ sey, wi go bi en shidren, bikos na so E wont am.


I tell una true word, anybody wey nor receive God Kingdom like small shidren, nor go ever enter inside.”


So di priest oga dem and di tishas kon ask Jesus, “Yu dey hear wetin dem dey tok?” Jesus ansa dem, “Yes! Una neva read sey, “ ‘Na shidren and small pikin wey dey suck breast go praiz God?’ ”


Den Jesus tell am, “God go bless yu, Simon, Jonah pikin, bikos na my Papa for heaven show yu dis tin, nor bi human being.


Yu don tish shidren and small pikin, so dat dem go fit tok about yor pawa and how Yu take silent yor enemies and doz wey dey oppoz Yu.


Wen e don si am, e go koll en friends and neighbours gada kon sey, ‘Make una kom follow mi happy, bikos I don si my money wey lost before.’


Den wen yu si am, yu go karry am for shoulder, dey happy.


Di Oga yor God dey with yu and E dey always diliver yu. E dey happy well-well bikos of yu. En love nor go make yu fear again and E go dey sing sweet songs bikos of yu.’


God sey, “Heaven na my throne and na di eart I dey put my leg. Wish kind house una go fit build for mi? Wish kind place I go stay?


But wen e si all di good tins wey en sofa bring, belle go sweet am. My savant wey I like well-well, go bear plenty pipol ponishment and I go forgive dem bikos of am.


So I go still do tins wey go dey sopraiz dem: tins wey dem nor go undastand. Wise men nor go get anytin to tok; doz wey get sense nor go fit esplain wetin dey happen.”


So, dem kon roll di stone komot from di grave mout. Den Jesus look heaven kon sey, “Papa, I tank Yu sey Yu dey always hear mi and dey do di tins wey I ask from Yu.


Like yong man wey marry virgin, na so too en wey form una, go marry una. As husband dey happy with en wife, na so una God go dey happy with una too.


One fine road go dey der and dem go koll am, “Holiness Road.” No sina go travel pass dat road and foolish pipol nor go fit deceive doz wey dey waka pass der.


God na friend to doz wey dey fear am and E dey tish dem en kovenant.


Na God get di eart and evritin wey dey inside. Di world and evribody wey dey stay inside, na en own too.


But wen e si many Farisee and Sadusi pipol dey kom make e baptize dem, e kon tell dem, “Una, snake shidren! Who warn una about God judgement wey dey kom?


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka