Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 1:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Dem nor get pikin, bikos Elizabet nor fit get belle and dem don old well-well.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 1:7
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Na faith make Abraham born, even doh Sarah don too old to get belle and Abraham don old too, but e know sey di Pesin wey promise am pikin, na Pesin wey e fit trust.


Elkanah get two wife; di first one name na Hannah, while di sekond one na Peninnah. Peninnah get shidren, but Hannah nor get.


Abraham and Sarah don old well-well and Sarah don stop to si en period.


Isaak pray to Oga God for en wife, bikos e neva born. God ansa en pray and en wife Rebekah kon get belle.


So Elisha tell Gehazi, “So na wetin yu wont make I do for am?” Gehazi ansa, “Dis woman nor get pikin and en husband don old.”


Abraham bow take face tosh groun, but e bigin laf wen e tink for en mind dey sey, “Man go fit born pikin wen e don rish hundred years? Abi Sarah fit born pikin naw wey e bi ninty?”


Abraham nor komplain for one day, even wen e don old nearly rish hundred years. Even doh E know sey en body don nearly die and en wife Sarah nor go fit born again,


Naw, David don old well-well and even wen dem kover am with klot, kold go still dey katch am.


Wen Rashel si sey e nor fit born shidren for en husband, e kon dey jealous Leah, en sista. Den e tell Jakob, “Make yu give mi shidren or I go die!”


For di time wen Herod bi King for Judea, one priest dey wey en name na Zekaraya from Abijah family and en wife name na Elizabet, wey kom from Aaron family.


Dem dey do wetin God like, dey follow all di tins wey God tok for en word.


E kom rish Zekaraya family turn to do priest work for di temple


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka