66 So evribody wey hear wetin happen, keep am for dia mind dey sey, “Wish kind pikin dis one go bi sef?” Bikos God dey with am true-true.
God pawa dey with dem and many pipol wey bilive kon bigin dey follow Jesus Christ.
Den Jesus follow dem go Nazaret kon dey do wetin dem tell am. But en mama keep all dis tins for mind.
But Mary keep wetin e hear for en mind kon dey tink about am.
God dey with Josef and evritin dey betta for am, even as e dey for en Egypt oga house.
“Make una nor forget wetin I won tell una, dem go sell God Pikin give human being.”
Di pikin kon grow, dey strong, e get sense and God favor, dey with am.
Di pikin kon dey grow and strong for spirit. E stay for wildaness until di day wen God show am to Israel pipol.
I don keep yor word for my heart, so dat I nor go sin against Yu.
I go support am with my hand and with my hand wey get pawa, I go make am strong.
Naw God give Elijah pawa, so e tie en rope round en waist kon run with leg pass Ahab go Jezrel.
One of en savant kon sey, “I don si one of Jesse pikin wey dey Betlehem wey know how to play di jita. E dey strong and e get mind; e know book and e fine well-well, bikos God dey with am.”
Naw, Samuel dey serve for God house. Di boy wear klean linen klot.
Josef brodas kon dey jealous am, but wetin Josef tok, en papa keep am for mind.
Make Yu support di ones wey Yu choose; di ones wey Yu raiz for yorsef!
Wen una first hear about di Good News wey bring trut, una kon get love and faith for wetin God prepare for una for heaven and na dis gospel