58 En neighbour and rilashons hear sey God don do big tin for am, so dem kom happy with am.
Wen pipol dey happy, make una follow dem happy and wen dem dey kry, make una follow dem kry too.
So Elizabet kon sey, “God don do big tin for mi for my old age, E don favor mi for pipol present and E don komot shame for my face.”
Di pikin go bring joy and happiness for yu and many pipol go happy well-well wen dem born am,
If one part dey sofa, di oda parts dey sofa too. But if dem praiz one part, di oda parts go dey happy.
Woman wey nor get pikin, E dey gi-am shidren kon make am dey happy. So, make wi praiz God!
Sarah kon sey, “God don make mi laf. Evribody wey hear wetin don happen, go follow mi laf.”
Una don do betta tin for mi and my family as una save awa life. But di mountins too far, before wi go run rish der, di fire go kill us for road.
Di time kon rish for Elizabet to born, so e kon born boy.
Jesus still tell di man wey invite am, “Wen yu dey do party, nor invite yor friends, brodas, rilashons and neighbours wey get money, so dat wen dem dey do dia own party, dem go invite yu too.
Make yu do wetin go make yor papa and mama happy for yu, so dat yor mama nor go regret sey e born yu.