57 Di time kon rish for Elizabet to born, so e kon born boy.
But di angel tell am, “Make yu nor fear Zekaraya, bikos God don hear yor prayer. Yor wife Elizabet go born boy pikin for yu and yu go koll am, ‘John.’
God nor bi like man wey dey lie and E nor bi human being wey dey shange en mind. Anytin wey E promise, E dey do am; Anytin wey E tok, na so e go bi.
For di time wen Herod bi King for Judea, one priest dey wey en name na Zekaraya from Abijah family and en wife name na Elizabet, wey kom from Aaron family.
Mary stay with Elizabet for about three monts, den e kon go back to en house.
En neighbour and rilashons hear sey God don do big tin for am, so dem kom happy with am.