Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Luke 1:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 Zekaraya ask di angel, “How I go take know sey wetin yu tok so go happen? Bikos mi and my wife don old well-well.”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Luke 1:18
10 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Abraham bow take face tosh groun, but e bigin laf wen e tink for en mind dey sey, “Man go fit born pikin wen e don rish hundred years? Abi Sarah fit born pikin naw wey e bi ninty?”


Mary tell di angel, “How dis tins go fit happen, as e bi sey I neva sleep with man before?”


One of di king ofisas ansa, “Abeg. Dat nor fit happen! Even if God ensef dey drop food from heaven, e nor go fit happen!” Elisha ansa, “Yu go si am dey happen, but yu nor go ever chop from am!”


But Abram sey, “My Oga God wey get pawa, na wetin go bi di sign to show sey I go get all dis land?”


Dem nor get pikin, bikos Elizabet nor fit get belle and dem don old well-well.


Den King Hezekaya ask, “Wetin bi di sign to show sey I go fit go di temple again?”


So Sarah kon laf and tell ensef sey, “Naw wen I don old well-well so, I go fit still enjoy to born pikin? Even sef, my husband don old too.”


Abraham nor komplain for one day, even wen e don old nearly rish hundred years. Even doh E know sey en body don nearly die and en wife Sarah nor go fit born again,


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka