11 God angel appear to Zekaraya for di altar side near where dem for dey burn incense.
God angel appear to Manoah wife kon tell am, “Even doh yu neva fit born pikin, yu go soon get belle and yu go born boy.
Den di sixt angel blow en trumpet and I hear one vois dey tok from di for horns wey dey di gold altar for God present.
All di angels na savants and na dem God send go prish for pipol wey go get salvashon.
But for dat nite, God angel open di prison door kon bring dem kom out and tell dem,
Di angel tell dem, “Make una nor fear! Make una listin well, bikos I kom tell una news wey go make pipol happy.
Di angel kon tell am, “I salot yu o-o! Yu wey God don favor, bikos E dey with yu.”
Di angel ansa, “I bi Gabriel, wey dey stand for God present and na-im send mi kom tell yu dis Good News.
God do wetin Manoah ask for and en angel kom back kon meet di woman wen e sidan for field. Dat time, en husband Manoah, nor dey with am.
For God present, e go put di incense for fire and di smoke wey dey kom out from di incense go kover di Kovenant Box make e for nor si am kon die.
God angel appear to dem and God glory kon dey shine for evriwhere, den fear katch dem.