10 But korn ofrin wey dem nor kook, weda dem mix am with oil or dry am, na Aaron sons get am and dem must share am among dem.
As tins bi naw, di money wey una get go help dem as dem nor get, so dat one day, di money wey dem go get go still help una wen una nor get, dat time evritin go kon dey ekwol, bikos
Wen dem measure with one omer, di pesin wey gada plenty nor get pass who gada small: evribody gada wetin e go fit chop finish.
Evry korn ofrin wey dem bake for oven, pan or iron plate, na di priest wey offa am to God, get am.
“Dis na di law for di peace ofrin wey dem sakrifice give God.