Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Levitikus 5:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 “ ‘If anybody know sey e dey guilty for wetin e do, dat pesin fit go konfess en sin.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Levitikus 5:5
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Yu nor go ever susid for life if yu try to hide yor sin. Konfess and stop to do dem and God go show yu mesi.


e must konfess and pay for evritin kon add twenty percent join for di pesin wey e sin against.


Una shidren-shidren go konfess both dia sin and dia grand-grand papa own, wey rijet and dey sturbon to mi,


E go put en two hand for di goat head kon konfess all Israel pipol evil, sin and sturbones for di goat head, den drive am go di wildaness.


If yu bilive and prish with yor heart give pipol sey Jesus Christ na Oga God, God go save yu.


So Joshua kon tell Akan, “My pikin, respet Israel God make yu praiz am! Tell mi wetin yu do; nor deceive mi at-all!”


I pray to God kon konfess all di bad tins wey wi don do sey: “God! Yu get pawa well-well and wi dey honor Yu. Yu dey keep yor promise and Yu love pipol wey love and dey obey Yu.


But make una first gri sey una don sin against mi wey bi di Oga una God. Make una konfess sey una nor dey obey my kommand and una don show una love to oda gods for under evry green tree.” Mi, wey bi God, don tok.


So, I konfess all my sins kon stop to hide all di bad tins wey I dey do. I tell mysef sey, “I go konfess my sins to God.” And E really forgive mi!


Di pesin go sing give odas sey, ‘I sin kon do wetin dey bad, but God nor ponish mi as e suppose to bi.’


As di priest give dis sakrifice, God go forgive di man. Di remainin flower na di priest own, just as e bi for korn ofrin.’ ”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka