Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Levitikus 5:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 “ ‘Or if yu tosh anytin wey nor dey klean and yu nor know; sometin like dirty animal wey don die. Wen yu kon know wetin yu do, yu must show sey yu nor dey klean again and yu don sin.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Levitikus 5:2
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

“If anybody break God kommand and e nor know, di pesin dey guilty and e must pay for en sin.


Make una nor chop pig. E get strong leg wey divide, but e nor dey shew, so e nor dey klean. Make una nor chop dis animals or even tosh dia dead body.


Den Haggai ask again, “Wot of pesin wey dirty bikos e tosh dead body; if e tosh any of dis food, dat mean sey di food dem don dirty too?” Di priests ansa, “Yes!”


Since una dey forbid am, make una nor chop dia meat or tosh dia dead body.


Christ still sey, “Make una kom out and separate unasef from dem,” and “Make una nor tosh anytin wey nor dey klean, den I go welkom una


“Curse dey una head! Una bi like grave wey pipol dey mash pass and dem nor know sey na grave.”


All of una wey dey karry di temple tins, make una know sey God go save una from Babilon. So make una nor tosh anytin wey dem dey forbid; make una make unasef holy, so dat una nor go die.


So God, how I won take know all my fault? Make Yu klean mi from di bad tins wey I do wey I nor know.


If anybody tosh wetin nor dey klean, (weda na human being, animal or anytin) den kon chop dis ofrin meat wey dem give God, dem go remove di pesin from di kommunity.”


May bi pesin make vow wey e nor sirious about, no matter wetin e bi, e don kommit sin wons e know wetin e do.


“ ‘If na Israel pipol kommit sin by mistake kon break one of God kommand and dem nor know, dem still don sin bi dat.


“ ‘Or if yu by mistake tosh sometin wey dey make pesin dirty for God eye, den wen yu know, yu must gri sey yu don sin.


Make una nor chop dis meat or tosh dia dead body; bikos dem nor dey klean.


Anytin wey unklean pesin tosh, go dey unklean and any oda pesin wey go tosh am go dey unklean till evening too.’ ”


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka