Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Levitikus 3:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Di man go put en hand for di animal head kon kill-am for di door-mot for di tent where dem for dey do meetin. Den Aaron sons wey bi priests, go rub di blood for di altar four side

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Levitikus 3:2
23 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

“Make yu bring di melu kom di tent front where dem for dey do meetin, den Aaron and en sons go put dia hand on-top di melu head.


Di One wey nor dey sin, God make am awa sin, so dat inside am, wi go kon dey good for God eye.


So God don raiz en savant and E don send am give una, make e for bless and help una turn from sin kom meet am.”


Una kill di pesin wey dey give pipol life, but God raiz am from deat and wi bear witness sey dis na true.


“Den I go pour my spirit to pray and to show mesi for David shidren-shidren body and di oda pipol for Jerusalem. Dem go dey look mi, di pesin wey dem shuk, den dem go mourn like pesin wey dey mourn en only pikin. Dem go kry well-well like sey na dia first boy pikin die.


All of us bi like sheep wey don lost and wi dey waka go awa own way. But God gi-am di ponishment wey suppose bi awa own.


Den Moses bring di sekond ram wey dem go use take anoint di priests, den Aaron and en sons put dia hand for di animal head.


E go kill-am for di nort side for di altar and di priest go put di animal blood for di four side for di altar.


Dem go kill di melu for where God dey for di tent door-mot where dem for dey do meetin.


Den yu go kill di ram kon rub en blood round di altar.


kon give all dis parts for di animal to God as food ofrin: all di fat wey dey inside di animal intestine;


Una go put una hand for di animal head kon kill-am for where dem for dey do meetin for di tent door-mot. Di priest go rub di blood for di altar four side


“But make yu nor take money for di first-born for melu, sheep or goat, bikos dem dey holy. Yu must kill and sprinkol dia blood for di altar kon burn dia fat for di ofrin wey dem make with fire wey get betta smell to God.


Yu go take one ram kon sey make Aaron and en sons go put dia hand on-top en head.


Yu go take di sekond ram, den Aaron and en sons go put dia hand on-top en head.


Anybody wey kill animal like melu, sheep or goat among Israel house for dia kamp


and e nor take am go di tent gate as ofrin to God, e don kill bi dat and e nor go dey among Israel pipol again.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka