Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Levitikus 26:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Una go ovakom una enemies.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Levitikus 26:7
13 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

I go give una peace for una land and fear nor go katch una wen una dey sleep. I go kill all di wild animals for di land and war nor go dey der.


Five of una go fit win hundred pipol and hundred of una go win 10,000 pipol.


How one pesin go fit porshu 1,000 among dem and two pipol porshu 10,000; if nor bi sey dia Rock sell dem and dia God give dem to dia enemies?


Di Jew pipol for di oda aria still gada defend demsef kon kill 75,000 of dia enemies, but dem nor tif or karry dia propaty.


“I go make some among una wey una enemies karry go dia land dey fear well-well, sotey if una hear leaf sound wey breeze blow, una go dey run. Una go run like sey dem dey porshu una for war and una go fall wen no enemy dey near una.


God go make una win una enemies wen dem attack una. Dem go from one side attack una, but dem go skata and run from una for seven side!


Only one of una fit make 1,000 pipol run, bikos di Oga una God dey fight for una as E promise.


But Barak porshu di war horse and Sisera men go Haroshet-Haggoyim kon kill all of dem for der.


Israel pipol from Naftali Asher and Manasseh tribes kom out kon porshu Midian pipol.


One donkey wey dem just kill, Samson si en bone for groun. So e pick di bone kon use am kill 1,000 Filistia sojas.


Jonatan and en savant kon waka go with dia belle for groun. E attack all Filistia sojas for der and en and en savant kon kill dem.


Wen Ammon pipol si Aramean pipol dey run, dem too kon start to run from Abishai go inside dia town. Den Joab and en sojas kon go back to Jerusalem.


Make pipol wey hate God, fear as dem si am; make disgrace follow dem forever.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka