Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Levitikus 22:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Nobody from Aaron family wey get diziz or dey discharge go chop di holy ofrin until e don dey holy. Pesin wey tosh anytin wey nor klean, bikos di tin tosh pesin wey don die; man wey dey discharge;

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Levitikus 22:4
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

God tell Moses: “Make yu tell di priest wey bi Aaron sons sey, ‘For pesin wey don die, make any priest nor go dirty ensef bikos e go di burial.


“ ‘If any animal wey yu suppose chop die on en own, anybody wey tosh en dead body go dey unklean till evening.


All di special ofrin for di tins wey dey holy wey Israel pipol give to God, I don give dem to yu and yor shidren forever. E go bi salt kovenant forever to God and na for yu and yor shidren-shidren.”


Out of all di ofrin wey holy well-well wey dem nor put for fire, dis go bi yor own: evry ofrin wey bi dia own, weda na from dia korn ofrin or from dia klean ofrin, or evry ofrin wey dem give mi, go dey holy well-well for yu and yor sons.


Di pesin fit chop di food wey dey holy well-well and di holy food wey bi God own,


Di remainin ofrin na di priest own; e dey holy, bikos dem take am komot from di food ofrin wey dem give God.


Di remainin korn ofrin na di priests own; e dey holy, since dem remove am from di food wey dem give God.


Anytin wey dem do with klot or leda and di discharge tosh am, dem must wosh am and di tin go dey unklean till evening.


Den Haggai ask again, “Wot of pesin wey dirty bikos e tosh dead body; if e tosh any of dis food, dat mean sey di food dem don dirty too?” Di priests ansa, “Yes!”


But di man wey nor dey klean or neva klean ensef, go remain unklean, bikos dem neva sprinkol di klean wota for en body. E don spoil Tabanako and dem must separate am from God pipol.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka