3 “E go fit enter di place wey holy well-well only afta e don bring one yong melu for sin ofrin and one ram for burnt ofrin.
“ ‘If na di High Priest sin kon make di pipol dey guilty, e go give one yong melu wey dey okay to God for en sin.
But na only di High Priest dey enter di Holy Place wons a year. For der, e go first offa blood for en sins, before e go offa for di pipol own, bikos dem nor know wetin dem suppose to know.
Moses bring di ram for di burnt ofrin, den Aaron and en sons put dia hand for di ram head.
“ ‘If di man dey give one sheep or goat, e must bi man own wey dey okay.
Na wons Jesus enter di place wey holy pass. E nor enter with goat or ram blood, but na with en own blood, so e don save us forever and ever.
Den yu go tell Israel pipol sey, ‘Make dem take one goat for sin ofrin, one melu and one lamb wey bi one year wey dey okay kon use dem as burnt ofrin,
E bring di yong melu for di sin ofrin, den Aaron and en sons kon put dia hand for di melu head.
“ ‘If na burnt ofrin from en animals, e must bring man own wey dey okay kom Tabanako, so dat God go asept am.
God kommand Moses,
“E go give one melu as sakrifice make God for forgive en and en family dia sins.
tell Aaron, “Make yu take one yong melu and one ram wey dey okay kon give dem to God. Di melu go bi for sin ofrin, while di ram na for burnt ofrin.