Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Levitikus 11:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Make una nor chop dis meat or tosh dia dead body; bikos dem nor dey klean.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Levitikus 11:8
22 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

To chop, drink and to do serimony take klean pesin body, na-im koncern dem. All dis one na rule for dis world, until di time wen God go bring di new law.


So make una nor let anybody take food, drink, party, new moon or Sabat Day matter, take judge una.


Israel pipol nor go stay for God land again, but dem go-go back to Egypt, den for Assyria, dem go chop food wey dem dey forbid.


All of una wey dey karry di temple tins, make una know sey God go save una from Babilon. So make una nor tosh anytin wey dem dey forbid; make una make unasef holy, so dat una nor go die.


“ ‘Or if yu tosh anytin wey nor dey klean and yu nor know; sometin like dirty animal wey don die. Wen yu kon know wetin yu do, yu must show sey yu nor dey klean again and yu don sin.


Make una nor put hand for bad tins, instead, make una dey espose dem.


Christ still sey, “Make una kom out and separate unasef from dem,” and “Make una nor tosh anytin wey nor dey klean, den I go welkom una


But wi know sey food nor fit bring us klose to God. Wi nor go luz anytin if wi nor chop or sey wi gain anytin if wi chop.


E betta make yu nor chop meat, drink wine or do anytin wey fit spoil yor brodas faith.


‘Wi advise sey make una forbid meat and blood wey dem don sakrifice give juju and any animal wey una kill wey en blood nor tosh groun. And make una nor sleep with who una nor marry.’ If una forbid all dis tins, una go do well!”


E tell dem, “Una know sey di law nor allow us, wey bi Jew pipol, to visit Gentile pipol or follow dem do anytin, but God don show mi sey make I nor sey anybody nor dey klean.


E kon tell dem, “Na so una fool rish? Una nor know sey anytin wey from outside enter pesin belle nor go fit make am dirty for God eye?


Nor bi wetin enter inside pesin body go make am dirty for God eye, instead na wetin kom out from en mout, dey make am dirty.


Dem kon si sey Jesus disciples dey chop bread wen dem neva wosh dia hand.


Na all dis tins dey make pesin dirty, nor bi bikos pesin chop with en hand wey e nor wosh.”


Nor bi wetin pesin chop dey make am dirty, but na wetin e tok from en mout.”


Pig nor dey klean, bikos e get two toes, but e nor dey chop en vomit.


“ ‘Dis na di animal for wota wey una fit chop: Any animal wey get both fin and skale, weda e dey sea or river.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka