3 Evritime, na only mi E dey always ponish.
but dem fight against am kon make am vex. So God kon bi dia enemy and E fight against dem too.
God dey vex for en pipol and E don ready to ponish dem. Mountins go shake and pipol wey die, dem go leave dia dead body for street like dirty. God vexnashon nor go end for der, but E go still ponish dem.
I go take akshon against una. I go make una dey pure like iron wey dem burn, den una go dey klean.
If I don ever do bad to who nor get papa and mama, bikos I know sey I go win di matter wen wi go kourt,
God nor dey ready to forgive dat pesin. Instead, God vexnashon and jealousy go raiz for di pesin and all di curse wey dey dis book go bi en own.
Yor arrow don shuk mi. E don wound mi well-well
God arrow don enter my body and dia poizin dey flow inside my spirit. God don make mi dey fear.
I dey live for peace before, but God don skata mi. E seize mi for my neck kon skata my life. E dey plan against mi.
Una wey bi my friends! Make una sorry for mi naw, bikos God don nak mi fall with en hand.