Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Kolossians 4:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Aristakus, wey follow mi dey prison dey greet una and Mark wey bi Banabas kousin (wey wi bin tell una sey, if e kom meet una, make una welkom am) dey greet una too.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Kolossians 4:10
17 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Mark, Aristakus, Demas and Luke, wey bi my ko-workers, dey greet yu too.


Na only Luke dey with mi. Make yu karry Mark follow body wen yu dey kom, bikos e go fit help mi for di ministry work.


Di whole town kon dey shake with nois and all di pipol rush go di stadium dey drag Gaius and Aristakus and di Masidonia pipol wey dey escort Paul.


Wi enter one ship from Adramyttium wey won travel go difren place for Asia sea kon bigin travel go Aristakus and one Masidonia man wey dey stay Tesalonika, follow us.


Pipol wey follow Paul go, na Sopata, wey bi Pyrrhus pikin wey kom from Berea; Aristakus and Sekundus wey kom from Tesalonika; Gaius from Derbe; Timoti with Tikikus and Trofimus wey kom from Asia.


Wen Pita eye don klear, e kon waka face Mary house wey bi John Mark mama, where many pipol gada dey pray for am.


God pipol for di church wey dey Babilon dey greet una and Mark, my pikin, dey greet una too.


Make una greet my kousin Andronikus and Junia wey dey prison with mi before. Di apostles dey respet dem and dem too don dey follow God, before I even know Christ.


Make una welkom am with God name as God shidren suppose do. And make una gi-am anytin wey e nid; bikos e don help mi and oda pipol before.


Paul and di pipol wey follow am kon travel from Pafos go rish Perga wey dey for Pamfilia, but John Mark leave dem kon go back to Jerusalem.


So Josef wey kom from Levi tribe and wey di apostles dey koll Banabas (wey mean pesin wey dey enkourage pipol) and en home-town na Cyprus,


Wen dem rish Salamis, dem kon dey prish God word for di Jew sinagog, (John dey der dey help dem.)


Banabas and Saul kon go back to Jerusalem wen dem don finish dia work and dem take John Mark follow body.


Epafras, wey dey prison with mi, bikos of Jesus Christ, dey greet yu.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka