Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Joshua 9:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Israel men kon tell Hiv men sey, “E fit bi sey una dey stay near us. So how wi go fit make promise with una?”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Joshua 9:7
14 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

No town make peace with Israel pipol (escept Hiv pipol wey dey stay for Gibeon.) Israel pipol win all di remainin towns,


I sey make una nor make kovenant with di pipol wey dey dis land and make una distroy dia altar, but una nor do wetin I tell una. ‘Wetin make una do like dis?’


Wen all di kings for Jordan River west; di kountries for hill; di ones for di valley go rish Mediterranean wotaside; plus di whole Lebanon (plus Hit, Amor, Kanaan, Periz, Hiv and Jebus pipol) hear about Israel pipol and wetin dem do,


For doz towns and kountries wey di Oga una God dey give una as where una go stay, make una distroy evritin wey dey inside dem.


una must drive all di pipol wey dey stay di land komot. Make una distroy all dia juju wey dem make with stone or iron and all di place where dem for dey woship di juju.


“Make una dey kareful, so dat una nor go make kovenant with di pipol wey dey di land wey una dey go, if not, e go bi trap for una.


I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay.


Hamor wey kom from Hiv, wen e pikin Shekem wey bi di prince for di land si di girl, e seize am kon sleep and disgrace am.


Na di nashon dem bi dis: Filistia pipol (doz wey dey under di five Filistia rulers), all Kanaan, Sidon and Hiv pipol wey dey stay for Mount Lebanon; from Baal-Hermon mountin go rish Lebo-Hamat.


But if una obey am kon do all di tins wey I tell una, den I go bi enemy to doz wey bi una enemies and I go fight doz wey dey fight against una.


Dem go di sout-side for Tyre town wey dem fence kon rish all Hiv and Kanaan pipol town and dem stop for Beersheba for Judah sout.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka