Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Joshua 5:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 Wen Joshua don near Jeriko, e look up kon si one man stand for en front and di man hold swod for hand. Joshua waka go meet am kon ask, “Yu dey with us, abi yu dey against us?”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Joshua 5:13
24 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den di donkey si God angel as e stand for di road with swod for en hand, so di donkey turn face di field. But Balaam beat di donkey, so dat e go turn face road.


Abraham look and e si three men stand for di oda side. Wen e si dem, e run go meet dem kon bow for dem.


Den God open Balaam eye and e si God angel as e stand for di road with swod for en hand; so e kon fall face groun.


But David nor fit go woship God for der, bikos e dey fear God angel and en swod.


I look up kon si one man wey wear linen klot: di belt for en waist na gold wey dem make from Ufaz.


My angel go-go for una front till una rish Amor, Hit, Periz, Kanaan, Hiv and Jebus pipol land and I go distroy dem for una.


As dem still dey look up as e dey go, two men wey wear white klot stand near dem


For inside vishon dat nite, I si one man dey ride one red horse, den e stop for one valley wey trees full and I kon si anoda red, brown and white horse wey get black spot for body, dey follow am for back.


God tell di angel make e remove en swod and e obey.


So Manoah get up kon follow en wife and wen e si di angel, e kon sey, “Na yu bi di man wey tok to my wife dat day?” Di angel ansa, “Yes! Na mi.”


I look up kon si one ram wey get two horn and e stand near di river. Di two horn long, but one long pass di oda one. Di one wey long pass, kom out afta di short one.


Manoah tell en wife, “Wi go die, bikos wi don si God!”


God kon tell Joshua, “Si, I won distroy Jeriko for una, plus di king and en sojas.


Wen Esau si di wimen and dia shidren, e kon ask, “Na who bi dis pipol wey dey with yu?” Jakob ansa, “Na di shidren wey God don give mi, yor savant.”


Jakob look up kon si Esau dey kom with 400 men. So e kon divide di shidren among Leah, Rashel and en two savant.


And di pesin wey stand for di lampstand centre, bi like Man Pikin. E wear long dress with gold belt for en waist.


God appear to Abraham near Mamre oak tree as e sidan for front of en house for one hot aftanoon.


Den Jakob wake-up kon sey, “True-true, God dey dis place and I nor know!”


Na almost evriday new pipol dey kom join David sojas. So en and en sojas kon plenty well-well.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka