29 Afta all dis tins don happen, Joshua wey bi Nun pikin and God savant kon die wen e bi one hundred and ten years.
Joshua wey bi Nun pikin, God savant, die wen e bi one hundred and ten years.
Den I hear one vois from heaven dey sey, “Make yu rite dis tins: “God don bless pipol wey bilive and obey Christ before dem die!” Di Spirit sey, “Blessing go really follow dis pipol and dem go rest from dia hard work, bikos of di good wey dem do.”
Pipol wey don die nor fit sing praiz God, bikos dem don die enter dia grave wey kwayet.
So Moses wey bi God savant kon die for Moab land, just as God bin tok.
So Josef die wen e bi one hundred and ten years. Afta dem don dress en body dem kon put am for one koffin for Egypt.
Josef stay for Egypt with en papa family. Josef stay for one hundred and ten years.
Den Joshua sey make evribody dey go and di pipol kon go back to di land wey dem divide give dem.
Dem beri am for di land wey dem gi-am for Timnat-Serah for Mount Gaash nort wey dey Efraim hill kountry.
Dem beri am for en land wey dey Timnat-Heres, for Efraim hill kountry, near di nort side for Mount Gaash.