“Naw, make una obey God kon dey loyal as una dey woship am with betta mind. Make una forget di gods wey una grand-grand papa dey serve before-before for di oda side for di river and for Egypt and make una kom woship God.
Efraim pipol nor go get anytin to do with juju again. I go ansa dia prayers kon kare for dem. I go give dem house like betta green fig tree and na mi go bless dem.”