Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Joshua 22:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Joshua give dem gift kon tell dem make dem go back to dia house.

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Joshua 22:6
18 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Den Joshua bless Kaleb, Jefunneh pikin kon give Hebron land to am.


Den Jesus take dem go Betany kon lift en hand and bless dem.


Wen e don give di sakrifice finish, e bless di pipol with God name


Moses si di work kon know sey dem do am, just as God kommand, so e kon bless dem.


Den Josef take en papa Jakob go meet Fero. Jakob kon bless Fero.


Den Simeon bless dem kon tell Mary, “Listin well-well: God don choose dis pikin to make some pipol for Israel fall and raiz odas up and e go bi sign wey many pipol nor go asept.


Many pipol wey kom from Efraim, Manasseh, Issakar and Zebulun nor dey klean, but dem still disobey kon chop di Passova food as di law tok. King Hezekaya kon pray for dem sey, “Make Oga God wey dey good, forgive


Afta, wen David go greet en family for house, Mikal kom meet and tell David for outside sey, “Israel king don fool ensef well-well today! E disgrace ensef for en girls savant and ofisas front!”


Eli go kon bless Elkanah and en wife sey, “Make God give yu many shidren thru dis woman and di shidren go replace Samuel wey yu dedikate give God.” Den dem go-go back to dia house.


Den Jakob bless Fero kon komot from der.


E bless Abram kon sey, “Make di Most High God bless Abram, di God wey kreate heaven and eart.


Den Joshua sey make evribody dey go and di pipol kon go back to di land wey dem divide give dem.


Samuel tell di pipol how di king go work. E rite evritin down for book kon put am for God present. Den Samuel sey make evribody dey go dia house.


Saul selet 3,000 men from Israel for ensef. 2,000 from di men, dey with Saul for Mikmash and for Bethel kountry for di hill; while di remainin 1,000 dey with Jonatan for Gibeah for Benjamin. E kon send di rest pipol go house.


kon give dem food. David kon give bread, rice and meat wey dem roast to evribody for Israel, den all of dem kon go dia house.


For di Fifteent day, Solomon kon sey make all di pipol go dia house. All of dem praiz God kon happy go dia house, bikos of all di blessings wey E don give David, en savant and all Israel pipol.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka