Biblia Todo Logo
Internet tuqin Biblia

- Anuncios ukanaka -




Joshua 22:29 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

29 “Wi nor go ever disobey God and wi nor go fit turn back from God kon build altar wey wi go dey burn ofrin or do sakrifice put, apart from di altar wey dey awa Oga God Temple!”

Uka jalj uñjjattʼäta Copia luraña




Joshua 22:29
16 Jak'a apnaqawi uñst'ayäwi  

Di pipol ansa, “Make God ponish us, if wi go woship anoda god!


Wetin wi go tok? Wi go sey God dey show parsha? No!


No! Why wi wey don turn from sin go still dey live inside am?


Wi nor fit tok so at-all! If God nor dey rite, na how E go kon take judge di world?


Na King Hezekaya skata all God place and altars kon tell Judah and Jerusalem pipol make dem burn incense and woship God for only one altar.


May bi yu go tell mi sey, “Wi dey trust di Oga awa God.” But na Hezekaya skata en high place, distroy en altars kon tell Judah and Jerusalem pipol sey, “Una must dey woship for only dis altar for Jerusalem.”


Nabot ansa, “I inherit dis vineyard from my grand-grand papa. God forbid sey I go give or sell am to yu!”


As for mi, God forbid sey I nor go dey pray for una again, bikos dat na sin. I go tell una di tin wey dey good and wey dey make belle sweet God.


“So wi kon agri sey make wi build dis altar, nor bi to burn ofrin or to sakrifice put,


If wi build altar for awasef kon turn from God as wi dey make ofrin and sakrifice on-top am or dey offa ofrin of peace for awasef, make God ensef ponish us.


But Josef tell dem, “I nor go fit do dat tin! Di man wey dem for si di cup for en hand go bi my savant and di rest of una fit go meet una papa with peace.”


Dem ansa di savant, “Wetin make awa oga tok like dis? E nor dey possibol for yor savant to do dat kind tin!


“Wi kon sey, ‘If dem tell us or awa shidren-shidren dis kind tin tumoro, wi go ansa dem sey, “Si di fine altar wey awa grand-grand papa build for God, nor bi for burn ofrin or sakrifice, but na to dey remind wi and una.” ’


Wen Finehas wey bi priest, di kommunity and di family leaders wey kom with am hear wetin Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe tok, body kon sweet dem well-well.


una must bring evritin wey I kommand una: una burnt ofrin; sakrifice ofrin; tithe and vow ofrin kom di place wey God choose as where dem go for woship and honor en name.


Jiwasaru arktasipxañani:

Anuncios ukanaka


Anuncios ukanaka